BREAKING: MAN. UNITED DON POUR PEPPER FOR MOURINHO BODY!

As tory dey break say Manchester United don finally tell their coach, Jose Mourinho make he komot for the club because say the bobo no too do well as dem expect o.


If una remember well well, Mourinho don spend better two and half years with the club before dey show am the door.

Mourinho, 55 years, collect FA Cup, Europa League and Community Shield for them even as e be say na number 6 position dem sit down for EPL.

“A caretaker-manager will be appointed until the end of the season while the club conducts a thorough recruitment process for a new, full-time manager,” United said in a statement.
“The club would like to thank Jose for his work during his time at Manchester United and to wish him success in the future.”

Shey una think say Mourinho be Manchester United yawa abi players?


No comments