Sponsored Post: Cryptic Pregnancy

Cryptic Pregnancy nah pregnancy wey be say, even person wey get am no dey know till after the person born the pikin.

This kind belle dey common among people wey be say dem don use all this birth control things tire {contraceptive pills or tubal ligation}. 






WETIN DEY CAUSE AM

1. Contraceptive Pills

2. Tubal Ligation

WETIN YOUR BODY O DEY SHOW YOU IF YOU GET CRYPTIC PREGNANCY

1.Fatigue (Body go just dey tire you anyhow)


2. Nausea and vomiting (you go dey trowey everything wey dey your belle)

3. Frequent urination (your belle no fit hold your piss again, nah so you just dey piss piss anyhow)

4. Weight gain (you go just dey fat even when you no see food chop)
5. Heartburn (your heart and belle go dey pepper you)

6. Headaches (your head go just dey hot like transformer)

7. Abdominal cramps (your abdomen do dey worry you)


8. Backache (your back go dey pain you like say you carry container for back)

WETIN MAKE THIS CASE DIFFERENT 

1. If you go do test, your piss and blood no go show anything (negative)

2. When this thing dey worry you, you go dey see your period, but he no go dey come regularly. 

3. You go dey get sign like say you wan enter labour.

4. Sign say your belle dey grow no go really show because for this case, nah the back of your belle dey pikin dey from grow.

No comments