Omotola Ekeinde : Girls For Know About Self Defence From Primary School
Top Naija Celebrity, Omotola Ekeinde don comeout ontop her twitter yarn say dem for dey teach girls from primary school about self defence.
She still yarn say women, after dem don mature to Adult, Make dem dey carry pepperspray dey waka because of bad men dem.
Wetin make her dey yarn this kind tin sef? Nah because of recent things wey dey happen to we ladies dem. She say for USA, nah right thing for ladies to dey carry am waka. Wetin una think if our ladies for here too dey do as their people for obodo oyinbo dey do?
No comments