See Gobe: Runtown Don Get Ban To Visit USA
One of Naija Ogbonge Singist, Douglas Jack Agu aka Runtown don collect bsn from AmericaPeople o,this means say him no fit enter Amelica for now o
Wetin Happen Sef
As we hear from him formal manager Johnson Adumike of Eric Many, him talk say Runtown and him brother get their US visa through Eric Many label, but like this now, Runtown brother no gree comeback to Naija oo.
According to Johnson, him say the kind visa dem get nah P-3 visa (visa wey allow artist as individual or group enter USA) and as Runtown brother no gree come renew am, Runtown no go fit travel to USA.
That be why Johnson report to USA Immigration.
Runtown and him mama wan travel, as dem go reapply for visa, dem tell dem say ban dey their head because if dem allow dem enter USA dem fit no come back to Naija. Oga Johnson come talk say ''Nah wetin person eye dey see if you try bite the hand wey dey feed you''.
No comments