SMALL DOCTOR CAUSE ANOTHER GBEGE FOR AGEGE WITH HIM CONCERT!
Agege Stadium no go forget the kind enjoyment wey Small Doctor, AKA Omo Better take sanma the place on Sunday 9th, December 2018 with him concert wey him call OMO BETTER CONCERT.
Before the show begin dey start proper, people don already full inside the Agege stadium like water, dey wait as dem dey enjoy small small gbedu as people dey wait for Omo Better make he show face .
E no too tey wey Small Doctor show face, people begin happy as the man of the moment start to dey give them him better performance. People no fit hide their sweet mind as dem follow they sing all him gbedu back to back.
As one tree no dey make forest, na him make Small Doctor carry people wey help am make the show sweet wella as other Naija ogbonge artiste them like Mayorkun, Mr Real, Vector, Reminisce, Junior Boy, L.A.X, CDQ, Oritse Femi and others them wey come support am for the show.
Him sef tok am say people no too believe am say e go fit do this kind paro when him announce the Venue for the concert. But him don give glory to baba God wey make the show happen.
See better pix:
No comments